My people My people, how una dey? We don get better gist for
una again ohh.
We thought the next time we would be writing on the PUMSA
Elections 2014 would be our coverage of the Inauguration/Handover ceremony, but
e be like say the 2013 excos fit sidon for that seat for more time (maybe some
go dey “lead” when dey don become House Officers or even as Youth Corpers).
The
gist be say the just concluded, abeg no be just, the Elections that ended
about 3 weeks ago don tie better wrapper. If you were in the right place in
School on Monday, the 16th of June, 2014 you would have seen a “certain memo”
from a “certain Dean” stating that our very own PUMSA election na cast and make
dey cancel Election wey all of us carry our leg and time come vote, abi we be
mumu to come vote wey dey go come dey use us play?
Abeg my people make una help us
judge this matter ohh. Wetin concern non-medical students with medical
election, we dey go help Humanities or Sciences go conduct their elections?
Even the “dean” wey talk the talk e no go go arrange our hostel matter well na
too dey carry head put for student election, Mtschew!!!!!!
Sha make we no make
any conclusion make we dey wait for the final verdict, even if they talk say
make INEC come conduct the election for us na their business…..
My better people now na you get the floor, make we hear your say on this delicate matter, drop your comments make wey dey continue this yarn!!!
Finally my
people……CHAI!!!!!!.......there is God ohhh
Mscheew. Rubbish. The person that won will still win. By an even wider margin sef. So the other camp should just save their time n enter a hole.
ReplyDeleteGbam!
DeleteWell said. Very sore losers. They should all cover their heads in shame after losing even with all the cheating.
ReplyDelete